Hey Guys

Fellow naija guys, and my african queens, How una dey na? welcome to my blog. I just dey write about everyday life in yankee town, so make una drop by, relax, read am, drop comment and also come back for more. Thanks.

Wednesday, May 7, 2008

Wahala dey o.

Trouble dey sleep yanga go wake am up o. For D town wey I dey stay most of the time, naija chikalas no plenty o. D ones wey dey don get bobo already and since we no get time to dey relationshsip with oyingbo we just dey nack quickies with any woman wey enter our trap. Na so me and my boy oga fineguy dey house, Na im we decide say make we cruise for oga fineguy new lexus, enter downtown go club small. As we enter club, we don switch level from serious college boys to horny cats on the prowl. We just dey sonch all d gals dem, dey decide which one we fit convince make we carry go house, make we go do the forbidden with. Fate smiled on us dat night, na im i meet one gal wey we been dey take d same General psych class the semester before, omo we begin yarn o, I dey spin my web, d gal sef dey digest am. Oga fineguy sef, don find im own level with one smallee like dat. As club close now, we dey carry d two beautfiul babes back home, for our mind we don chop dem already, we don dey think of the different positions wey we go nack, d think of how many condoms we go use dat night. We no know say wahala just dey follow us.

We just dey drive o, na im we hit red light o,as the signal change to green,we begin dey drive o, omo na one yeye car leave im lane come nack us,come leave big dent for oga fineguy new car. Trust naija boys we comot from the car, begin the raise holy hell, na so we dey blow phonetics like say tommorow no go come. Meanwhile as we dey do all this gragra, oga fineguy never tell me say im no get insurance for the car o. As police come now, begin dey ask for license and insurance information na where wahala begin o. Oga fineguy show license, e no get insurance, na so police give us 500 dollar ticket o, come tow the car plus. Luckily for us, the other guy was at fault, so his insurance had to pay for the damage to the car.

To add insult to injury, the policewoman come carry the two chikas wey we wan carry go house, go drop them for their house 'for their safety". The police woman tell us say we e no get space for im car, say we dey on our own o. Na so God punish us dat nite, na so we slam for leg 5 blocks down to our house in the dead of winter. pussy we no fuck, car we no get, Money to call cab we no get. Wahala plenti for this yankee o.

Reminds me of another incident, coupla months ago, two of my Homies from naija, enter yankee to go school. So d bobos dem come stay with me and oga fineguy, Since we no get anything to do apart from work, omo na so we enter club o, it was the slow season for club because of christmas break, since students don leave town go dey with thir family. Na im we come dey able to carry two chikalas go house o, since dis boys neva nyash oyingbo toto before na im we say make we dey hospitable, offer them condoms, tell dem make them nack first, but d rule be say nack to ur full, comot make another person nack. omo as dis boys enter room dem turn to microsoft corporation, na so dem monopolise d chicks all night, dem no gree comot from room, na so Me and oga fineguy jus dey outside with stiff boners dey listen to moans of pleasure all night. Bloody fucking pricks. Till today i still dey vex for them.


On a serious note though, Me and my boys dey talk the other day, since we don almost finish this school thing we don dey think of settling down with some cute naija ladies. Naija single ladies, what sayest thou?

2 comments:

Abujababe said...

U know say if u dey do all this one here for Naija, those "chickalas" go don give you "tufancha", enter and stay. lol

Omo calabar. said...

Irumma, I hear u o. if i dey naija, I no for do all this sha, u know say pastor pickin na dem, spoil pass,Lol.