Hey Guys

Fellow naija guys, and my african queens, How una dey na? welcome to my blog. I just dey write about everyday life in yankee town, so make una drop by, relax, read am, drop comment and also come back for more. Thanks.

Monday, July 21, 2008

Na wa o

How una dey na? I neva blog in a while o, U dey ask why? I be aajepako boy o, i gat hustle for school fees o. my people na so boys just dey jump from one job to the other for dis america way i come, so tey all d oyingbo don know me as oga overtime, na so my boss dey tell me and oga fineguy say "u two nigerians are making too much money in this company". Na im i tell am say na so e suppose be. Boys gat make money so we fit flex when time reach.

My people na so iphone 3G comot july 11, ah come see line where dey in front AT$T office na. People dey craze for this Iphone o. My people talking of iphone u no say levels dey for dis yankee. Na so me and oga fineguy just dey pose dey denge anyhow dey dream of day where we go enter naija go dey oppress home base naija boys, na so oga fineguy Uncle dey enter yankee next week o, the guy wan come yankee come buy 50 Iphones to go sell for naija. Omo na so i just dey open mouth o, as i dey so i no fit even buy 7 Iphones na so one person wan come buy 50. I dey talk with my bros d other day na so d guy just dey ask me if i dey enter naija xmas, na so i tell am say i neva know. Na im dey guy dey tell me say as if i come, make i no carry some yeye small change four thousand dollars come dey pose for naija, na so d bobo tell me say for every money wey i comot say him go double am. Omo fear catch me o, na dis one people dey talk say money no dey naija.

Na im i dey ask my bros say why old boy no dey gree pay my fees anymore, na so d guy yarn me say my old man still dey vex say i no go london go school, say i come choose to go school in America against his wish, dey study wetin im no want make i study, say i dey on my own o. Naija parents na wa for dem o, dey one dictate person life from A to Z, omo I rather suffer do program i wan do, than to let dem tell me wetin i gats do.

Omo na so my boss hire new chika for work o, omo baby gal fine no be small, na so i just dey watch dat nyash dey rotate, dey bounce as she dey waka. Omo dat gal nyash fit raise the dead o. Damn na so i just dey dream of nacking dat nyash o. Na God go save me o.

Omo d other day, I just decide say I go respect myself, dey with one gal. stop this womanizing and just be a good boy all through. Omo e neva even reach 3 hrs na so i get 3 calls from 3 different koklets, one of dem na one gal wey just dey do yanga gimme, Na im i give the first two appointment, na so i go block d third gal for her apartment, we just dey yarn, we come commot go c movies come back her apartment , na so baby gal no fit keep him hands from me o, for my mind i just tell am say u don die today.

My people i neva meet woman wey dey scream like dis gal o, i no say woman gats moan, when she dey feel dey koboko inside am. but dis gal na something else o. Na so d gal just dey scream, dey yell "oh my god, it feels so good, fuck me harder, oh my god, oh yes" sotey i gats stop twice in the middle of the nacking ask d girl wether she sure say she dey alright, na so d gal dey say" am alright, just keep fuckin me" being the gentleman i was, I had to oblige the lady. After three rounds and 3 magum condoms,na so d gal just dey tell me say she neva nack in almost 8 months o, say i don satisy am well well, omo na so calabar boy nod head, i come congratulate myself.

Abeg make una tell obama make d bobo dey careful dis wan wey im dey go middle east o. I dey fear o. My people i go dey keep una current on the happenings around dis yankee. Make una all take am easy and God bless.