Hey Guys

Fellow naija guys, and my african queens, How una dey na? welcome to my blog. I just dey write about everyday life in yankee town, so make una drop by, relax, read am, drop comment and also come back for more. Thanks.

Wednesday, May 7, 2008

Done

Finally brought the school year to a successful end dis week. I take my last finals for the semester. Omo e be like say dis oyingbo professors dem been wan kill me with heavy workload, I just dey thank God o, e been be like say this last semester for burn my nyansh well well. Na so ur bros just dey do business simulation, dey run from one business class to the other, dey run excel, minitab and office software like say tommorow no go come, but yeah am done and it feels good to be done.

Sun don dey shine for dis side sha, d wahala for spring be say all dem sexy mamacitas dem go dey shed their winter gear, na so so woman nyash boys dey look o, Damn thing is driving me insane.

So boys dey look to hustle dis school break, gats find some extra jobs to work ma arse off and make some money, money, e go better sha. I gats begin dey make application give all dem sugar mummies dem, make dem know say my resume dey very attractive, my stamina in d sack is impressive and I can shag as many times as possible a day as long as d finances can be handled, lol.

Anyhow my people make una enjoy sha o.

1 comment:

Buttercup said...

lol...its spring now here in SA, the revealin of bodies has begun!