Hey Guys

Fellow naija guys, and my african queens, How una dey na? welcome to my blog. I just dey write about everyday life in yankee town, so make una drop by, relax, read am, drop comment and also come back for more. Thanks.

Monday, May 12, 2008

dis yankee sef

Plenti things happen dis week o. I lost one of my friends dis past week, make una relax o, no be dat kind lost i dey talk about. This friend of mine, I go call am, Oga lyrical decided to take his relationship with his girl to a deeper level. I still dey try decide whether I like that idea or not because dis is a guy dat we go girl mongering together. The guy dey date this hot asian babee, na so the girl just steal my guy heart, na so so love my guy dey yarn this days.

Another of my guy, oga sexy just started dating this naija gal, i dey jealous d guy no be small. Na so bobo don begin dey fat, with all the good cooking and the good loving baby gal dey give am. The guy, ajepako pickin like me, where we dey hustle two jobs dey go school, now the guy dey do one job o, because the gal dey help pay most of his college fees. The girl is well loaded, since her popsi na senator for naija. Homeboy is just crusing around and enjoying life, while dey rest of my boys and I dey hustle for this yankee where we come.

E get one thing wey dey happen wey dey vex me well well for this yankee. The day where i decide go club with woman na dat day, gals go on their own accord begin dey flirt with me. The day wey i no go club with woman, na so me and oga fineguy go gat pull teeth to fit carry all at least one of dis yeye oyingbo gals go house. A couple weeks ago, i dey club with woman, i dey do good boy dey behave myself, as I wan dey on the girl good books so she fit let me nack. As my date for the night go ladies room, na so this American indian chikala, walk over just begin dey yarn with me o. After introductions, omo na so the gal ask me Point blank, "Dude, u wanna fuck me", I was like, "say what?", and she repeated her self and was like "we could go to my car or your place or wherever, i just wanna fuck". I was like Damn, perfect opportunity for a hard horseback riding in the back seat of the car, I could only take her number as my date for the evening was on her way back.

On a more personal note, I for nearly get another gal wahala this weekend. Na so I comot for work saturday night around 11pm rush go house go ready to hit club dat nite. I been don arrange to meet one sexy oyingbo chiakala like dat o. Omo as we dey drive dey go club now, d gal say she wan go dis particular club where me i dey avoid because of the wahala wey i jam for the club 2 months ago-Make I tell una d wahala wey happen, two months ago, I dey work for school library o, na so one of my co-workers angie dey tell me of her friend Jennifer where like me o, omo, na so I just dey strut, dey pose, dey flex anyhow, anytime jennifer dey around o. After enough flex for my side, na so jennifer invite me come im house one monday night, the horny fuck dat I was, i agreed, had dinner and gave the girl the koko all night. The poor gal probably taught I was the real deal and was expecting a relationship or something. After going back for second round tuesday and left overs on wednessday night, I no gree d call the gal anymore. After one week pass, jennifer call me one saturday night, ask me whether i wan go club, i tell am say i gat read for a class, the gal was like ok whatever. Meanwhile that same saturday night i deide go club with a different gal where oga fineguy introduce give me, Omo na so I Just dey chill with this new babe na im Jennifer enter club with her friends,na so wahala burst. All I could say was Damn, am fucked. Na so jennifer walk up to me begin dey shake ground, dey rake, dey do gragra,wan fight this other girl, na so club bouncers came to my hep and carry jennifer comot o. The gal where i carry go club sef don begin dey vex no be small, na im me i begin dey do big time damage control, because I no say i fit call jeniffer anytime, spin some yarns and get back into her pants but this new gal where i neva nack no go be the same deal. With much help from oga fineguy the situation was diffused- Luckily, the night went on without incident, even though i spent most of the night looking over my shoulder.


My people I want to put in a fresh application to all the loaded and unloaded naija gals in yankee, and all the sugar mummies in yankee, make una look una boy up now. I am a well endowed naija male, with great skills and stamina in bed, with a good sense of humour, please without sounding desperate make una holla back at me. LoL. E go better, My people make una take am easy o.

4 comments:

Unknown said...

Dinner on Monday, Seconds on Tuesday, Leftovers on Wednesday. Omo, you don spoil finish! LOL!! I go forward ya post to ya mama oh! LOL!!

Unknown said...
This comment has been removed by the author.
Anonymous said...

pussy is pussy,what matters is having -one dat lets u dig anytime and can fix u up.

Unknown said...

UPDATE!