Hey Guys

Fellow naija guys, and my african queens, How una dey na? welcome to my blog. I just dey write about everyday life in yankee town, so make una drop by, relax, read am, drop comment and also come back for more. Thanks.

Thursday, November 20, 2008

UPDATE

Gbosa i don land. Una been miss me? I don dey out of action for a coupla months now, its been a combination of school, extra school activities, work, relationship problems, no sex life etc. it has been a real tough semester i no go lie u. By the way i don broke no be small, before i dey make yanga give my boss for work before, nowadays i dey paddy up to the woman for overtime hours.

On to other gists, I wanna fuck. Yes o. Agro don catch me no be small. Dis past months i just dey on celibacy levels o, Calabar boi neva Kpensh in almost 3 months. Am going through serious shagging withdrawals, all in the name of commitment to nadia. I refuse to take the wanking alternative because am trying to keep to ma new year resolution of not wanking at all dis year.

What about nadia? The gal was able to get a job with microsoft and had to move to a different city. So we have just been doing the long distance thing, i no like am at all. Last time I visited her, i just dey siddon for air plane dey dream of plenti kpenshing that weekend, i dey imagine the different positions i go take bone the girl,i don even buy two packs of trojan dey prepare myself for serious action. Ahhhhhh to my utmost dissapointment nadia monthly visitor just showed up that evening, she offered a blow job, but it didnt cut it all. i just wan stick junior officer in a tight, juicy hole. kai i don die o.

Am at school at d moment, I just dey peruse all d sexy kokolets wey dey pass me, Na so i just dey imagine kpenshing one of dem. kai wahala plenti o. Last nite i was tempted to cheat on nadia, wetin concern me, i been wan chop clean mouth come put up innocent boy face give am. It all started with oga fineguy, the homeboy dey nyash one exchange student from uk, Na so those two just dey kpensh like say tommorow no go come. The gal sef na one of those girls wey dey sabi moan well well, as the two of them just dem kpensh all night, me i just dey my room dey get boner all nite.

The uk gal come our house the other day with one of her friends. Apparently oga fineguy don dey go behind the Uk gal dey nyash her friend, so d bobo dey push d friend gimme. Me sef i no mind chopping left overs, as long as dat toto sweet well well. i don dey yarn with the gal but guilty conscience dey catch me sha, cos i no want jinx the thing wey i get with nadia.

The way its going, i might have to wank. Guys una know say, when any bobo neva kpensh in a long time, d first time wey im go kpensh, bobo go turn to one minute man. God forbid bad thing, d kind embarras wey for catch me ehh, i 4 run enta hole. Omo Calabar is a stud, so am probably gonna have to wank to avoid any kind of unwanted disaster in the sack.

On a more serious note, nadia and I are gonna be meeting this weekend to discuss the state of the relationship, if theres a future in what we are doing or if we should just break up.

E be like say i go holla at lady koko, bombchell or afrobabe, tell dem say i get free spot on ma appointment book. Lol.

Thanks guys for the love, i do appreciate it.
P.s Happy thanksgiving in advance.