Hey Guys

Fellow naija guys, and my african queens, How una dey na? welcome to my blog. I just dey write about everyday life in yankee town, so make una drop by, relax, read am, drop comment and also come back for more. Thanks.

Sunday, February 3, 2008

wetin dey wrong with naija babes for yankee?

I dey talk with my ghana friend d other day about dis issue of marriage. Na so bros tell me say im no fit marry oyingbo woman o, say d idea say im go wake up for morning c white bodi beside am, no dey appealing at all. Bobo say when im ready 2 marry, say im go catch d next plane to accra go take im time, take look for proper ghana woman, carry come back yankee. Na so most of my naija friends dey yarn say dem dey go naija go find woman.
D question wey me i dey ponder on b say, if all of us dey go naija go marry, who go marry d naija women dem wey dey yankee? I believe say correct naija women dey for this oyingbo land wey boys fit relate with, marry. I no just dey d levels, wey woman for naija go tell u or do anything make u bring am come yankee, make im come change im color.
Na so my people for naija dey call, dey ask me say when i go carry woman come meet dem. dem dey tell me say plenty gals don dey wait for me make i come back from, na im i tell my uncle say when dem don tire to wait they go find another person marry. if i wan marry i go find one of naija ladies dem wey full dis country, take time know am, do d proper thing with am.