Hey Guys

Fellow naija guys, and my african queens, How una dey na? welcome to my blog. I just dey write about everyday life in yankee town, so make una drop by, relax, read am, drop comment and also come back for more. Thanks.

Sunday, January 27, 2008

Naija babes dem.

If visa official for embassy been tell me say make i reconsider going to yankee because i go dey live for place wey temperature go dey below zero, i for don rebuke am in jesus name, call am enemy of progress, My people sef for don fire prayer give am. But every winter for this God's own country na wa, na so man pickin go dey pack cloth full body like say tomorrow no go come. Na so i go dey resemble marshmallow dey waka around. But my people no be dat wan i been wan yarn sha.

I wan rub mind with una about naija babes for yankee o. Naija babes dem fine no be small, but wetin dey kill me na d shakara wey dem get. I mean e dey alright say gal gat pose, form levels small. But when u wan come form levels past me, na dey we got hit go slow o, because naija boys no dey carry last at all.

I don dey yankee for a minute but i never don dey able to date proper naija gal make e dey worthwhile, i mean i don date americanos, latin american gals, european gals and even some asian gals dem without wahala but when e come to naija gal, e be like say na curse.

Na so i come meet dis correct naija babe for school, i don dey relate with am, dey feel d babe levels, as i come begin dey talk make we comot, go c movies, siddon chop dinner for red lobster, u know do am d oyingbo style, omo na so d baby begin dey preach gimme me o. Na im i come dey wonder for my mind, sa na chris oyakhilome pickin abi na pastor adeboye pickin i come meet. Na im i just shun d babe.

I come meet another naija gal, omo baby fine no be small, we don even dey commot, dey relate, after two weeks of dating now, i don dey play good boy, e don reach time to comot for defense, play midfield small, she no gree o. she say no sex untill am married, na im i look am, for my mind i say shebi na me go marry u. Na i tell am make she dance far, i no want her wahala.

The next naija gal wey i meet, d gal gree make i play midfield o, as i wan enter her "18 yard box" na im baby say she dey reserve dat "part" for that special person. shey me i no look like special person. How special do i have to look. i mean baby gal dey smooch me merciless but she no gree make i "do".
Boys una know say body no be firewood na. No be say na "do" i just want from dis girl, i mean its just normal dat d "do" part has to come in a relationship, it compliments the relationship. After a couple months of useless smooching na so i shun am o, go dey meet oyingbo gal wey dey service me constant.

Since den, i don dey meet different naija babes dem, and all of dem dey claim jesus like say me sef i no be jesus pickin. I Mean i sabi bible well well o. King solomon no be im been get concubines wey im no marry, wey d bobo dey nyash any how. One naija gal even ask me say "as u wan date me so, shebi dis date go lead somewhere, shey u go wan marry me after a couple months", na im i run leave am quick quick.

So ladies and gentleman abeg make una tell me wetin i dey do wrong. I fine well well o, infact am a very handsome man. I won "Mr pretty" contest in secondary school. I never get wahala dating any african or caucasian gals, na only naija. wetin me i do wrong.